STUPID QUESTIONS PEOPLE ASK (JOKE)

1. You see identical twins, you still dey ask 'na
twins be dis'? No bros, na picmix..

2. Nepa brings light and everyone in the
neighborhood shouts 'Up Nepaaa'! My guy still
ask me, O boy na light be that?No oh, Na Sun fall
from sky!!

3. You see person dey vomit, you still dey ask am
'you no well'? Him well, e just wan see the food
wey him chop yesterday.

4. You just wake up from sleep; person come
ask you "you don wake?" No oh, I come buy
bread wey I go chop for dream.

5. You see woman wey born new pikin; u come
ask her "madam u don born? " No ohhhh, she buy
am for OLX..

6. You greet person "good morning ma" ! She
ask, my pikin you don wake???? No ohhhh, I dey
sleep walk... .

7. My guy ask me "O boy where u dey?" I tell am
say i dey bank, him com ask me "Wat is
happening there?" My brother dem dey celebrate
new yam festival..

8. My neighbour sees me opening the gates to
drive out and asks me, U dey comot? Not at all...
I be the new gateman...

9. I dey watch film… my guy enter come ask me
"Guy na film u dey watch? No I dey look d
future...

10. U see me dey chop indomie, u come dey ask
me, O boy, na indomie u dey chop so? No ohhhh.
Na fried rubber band..

11. U see me dey swallow panadol, u come dey
ask me "U no well" No ooo, I'm hungry.

No comments

Lawal's Official Blog. Powered by Blogger.